Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Educating Nigerians about Bitcoin
by
Miles2006
on 03/11/2023, 22:00:17 UTC
As I started my bitcoin journey last month I observe say bitcoin knowledge is very backward in the country and bitcoin knowledge na wetin everybody go fit acquire in a simple way. According to wetin Satoshi Nakamoto talk bitcoin is for everyone and people who become part of the technology, and that's why I'm using p2p. I come dey wonder for naija way we so I no know for your area but for my area i no too dey hear bitcoin, the thing no dey popular for my area. Most people never hear the word bitcoin for their life self, so how we go do?
Last time I wrote about a topic will Nigerians marketers accept bitcoin if legalize. I saw different comments say them go accept, but to accept bitcoin no be the problem, them get the knowledge about bitcoin? Because wetin person no know big pass am by far. People need to get a solid knowledge about bitcoin first before using it and how to secure their coins/wallet if possible make them get guide wey go guide them through because if bitcoin dey legalize for naija scammers go dey invent new methods every day just like the way scammers dey for fiat.
In essence I wan talk say make we dey teach about bitcoin for our area because as bitcoin dey grow so countries go make bitcoin dey legalize as the world dey develop with different technology and Nigeria no go dey left behind, I believe say Nigeria go make bitcoin as their legal tender one day. So make we start to dey teach the knowledge about bitcoin so that the thing no go dey new for people ear.
  • students/children I have seen many threads on children education and I also want to contribute my view, one thing I observe about children them dey very sharp when it comes to learning especially learning about technology. I go like say make we start to dey teach the younger ones about cryptocurrency(bitcoin). Teaching them about the advantages and disadvantages about bitcoin, the risk involve and everything wey person suppose know about bitcoin. Some go say wetin concern small pikin and bitcoin, so as long as the pikin don know good or bad that pikin fit learn about bitcoin, so creating the awareness of bitcoin to our children is one of the best idea.
    Here are some threads about educating children about bitcoin:
     https://bitcointalk.org/index.php?topic=5438924.0
    https://bitcointalk.org/index.php?topic=5432314.0
    https://bitcointalk.org/index.php?topic=5454984.160
  • business owners: I think if you're a business owner maybe you're into selling of goods, clothes or supermakert, is best if you accept bitcoin as your pay in return. By so doing you're creating the awareness of bitcoin to your customers for example a school principal accepting crypto (bitcoin) as a school fees payment, he also stated that he believe that one day digital money will gain more acceptance than paper money so he wants to be part of the technology now.https://cointelegraph.com/news/nigerian-secondary-school-will-accept-crypto-payments-despite-regulatory-uncertainty
Lastly bloggers, if you dey into blogging, make your site dey talk about cryptocurrency(bitcoin), cause everyone makes use of the internet everyday.
My brother Bitcoin no be wetin you go just wake up learn over night and understand they are still many things you need to learn ooo just last month now you don dey feel yourself say you don understand Bitcoin and the values behind am no be so still try check some topics about Bitcoin and some threads as you talk so Bitcoin no be everyone know am maybe your area no dey exposed thats why for my side even 15 year old know wetin them dey call Bitcoin and for today so wen e be say everything dey the internet I believe many people don hear am but them fit still never understand the potentials.
Why do you fail to understand my point dear, I'm not sure you understood what am trying to say. Besides creating bitcoin awearness no be me and you go do am as we be newbie so I see no point why you're commenting without understanding the post. Trying to teach me what to do, Everyday na person dey learn new things we make use of the internet for research and to acquire knowledge sha that one na true.