My brother this bike fine and e dey economical also and if you check the price too e dey fair. I no know which country you wan order from and the importation fees. My major challenge for this bike be say e fit make you dey stranded because the battery wey you charge fit finish unexpectedly for middle of road. Just like if petrol finish you go enter filling station. But for charging, e fit hard because normally light sef no dey Nigeria like that.
If you look am you go under say the country dey connected for suffering. Light sef no dey, petrol come expensive and people are looking upto gass now.
I know everyone has there own points but come to think of it okada man tire dey less for road and en dey push am go volcanizer abi? And fuel dey finish for some motor the owner dey push am go filling station Shay? So even if the electric bike battery off for road we go still push am go our house nah naija we dey, the only way to overcome this situations nah to dey very observant to the battery percentage and make we calculate the distance before we move go any destination, So my brother that one no be issues.
Make i chip in, for this matter so, shey na as you de drive, the battery go de charge, abi no be so e suppose be nw?
By the way to import am be the wahala, cos of custom duty clearance and Also with this kind of epileptic power supply we get, this one go be issue ooo, and no forget say na prepaid meter we de use for some areas like that..
Anyway make we just help ourselves de manage the country like dat