Thank you my brother, you don talk wetin motivate me the more, as you say you don go through wetin I dey go through now e really means a lot to me, you just needed more grease to my elbow to keep pushing.
You are welcome op, you don talk well, na wattin be the need to hold back knowledge wey you no say fit help your fellow brother if you share am? Na the little wey I fit do be this, I go also advice you make you commot body for any thing plagiarism or any thing or write up wey AI generate oo, because some persons just dey for this forum wey dey find wey to burst people account, and dem dey use AI detector, immediately dem copy paste your post for there e go just show the originality percentage of the post and before you ho know dem don report your account. Most especially their eyes dey for newbies, jr member, and member rank account, though dem still dey burst legendary, hero, senior, and full member account oo but e dey rear unlike the wey dem dey burst the other ranks, so abeg dey very careful any thing you dey copy from anywhere abeg no forget to put source wey you get am from.