Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Quick money wahala
by
letteredhub
on 10/11/2023, 15:18:38 UTC
Every body wan make quick quick Cash .Gone are the days when youths work hard to earn a living,them no send how the money take come..nai make now scammers full everywhere...nobody is safe . Government too is to be blamed Sha cuz if you go all these government offices no workers yet they won't  employ fresh graduates .Na only God go help us
The rot start from the top down to the bottom... everybody dey hustle to make am against all odds. Check how far our politicians are ready to go just to be in power. That is what is propelling the youths to do both legal and illegal just to make am. Many people dey even before them make am but the hustle continues.

I no really dey against working hard to make am, I no dey against fast hustle... wetin I dey against na quick money through illegal. Any money wey no give us rest or wey we get at the expense of other people blood or tears no really make brain.

Best na to remain clean dey push life small small dey go. If you find anything wey genuine, come dey put food for your table, abeg give am your best.

Wehn we the talk of quick money way boys and girls don the do anything just to make we the like to carry all the blame put for government head forgetting say we all anh part of the government in our own small small positions for the society. Jobs no dey but that one no give any person the excuse to use do evil things just to make money it's never justifiable in anywhere in the world. Now our mama and papa including brothers and sisters them no dey ask again where and how  person go make him/her money as in them no care how you take make am, their own be say just make am weda by croak or hook and nah this ideology nah the give young youth's the mindset to do anything even to kill human being just to make money cos them know say nobody go interrogate them how them make the money. Them go just see you as big boy/girl the claim day nah God run am for you... Which God be that?

This way we don turn out society to don make even the young people way wan try hustle beta hustle to earn legit income we no the regard them as serious people for life bcos their money no long. Na wetin make all the guys wan run street make them ball too at all cost.