Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nija sun fit knack sense comot for your brain
by
Makus
on 13/11/2023, 16:31:31 UTC
My brother i think say na only me dey experience that thing  for were i dey ooo, nija sun no be for here ooo especially this sokoto were i dey wey be desert area the sun wey we dey experience for here fit fry yam i dey tell you but me that i have face cap i don use to complain the wey the remaining people do, and in time of rainy season we don use to have excess of rain here.

So if i am you i will just go for face cap, but i don't no your power but for me that can not afford umbrella i only go for face cap.

For this part of the south side of naija wey I dey I go say, the sun don dey reduce unlike rainy season period wey everybody dey expect rain but las las na better heavy sun naim come be dey shine, I no go lie the kind of sun wey dey naija fit boil water wey person fit use make EBA  and the major cause na all this buncry aka illegal refinery wey men dey do for this side naim make the sun dey affect us like this for this side wey be rain forest. I remember that year for biology class wey my teacher tell me say the aggressiveness of African animal na due to the high radiation from the sun wey dey touch their skull, naim make African animal are the most aggressive worldwide.