Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: The fall of shitcoin/altcoin, the rise of bitcoin
by
Odohu
on 14/11/2023, 21:31:13 UTC
I greet ona o. I just dey reason how many coin don surface for air after bitcoin. So many of them don fall finish. If you go coingecho or any crypto website, you go see say na everyday coin dey enter market and naso them get short life spam. People wey never know wetting the happen go dey buy am dey Happy say there future don bright not knowing say na junk then they buy. Tera Luna and FTT coin show people shegge and other ones wey I no no. Now people come dey realise say na bitcoin be the Koko. So I come they think wether na these things wey happen to people naim increase bitcoin adoption pass the way e been dey before or bitcoin for just grow without these things wey I talk.

Abeg make ona shear ona idea on wetting ona think dey increase bitcoin adoption
I been make one post like that for the Bitcoin Discussion board where I said that it is Bitcoin and nothing else. Omo my experience with shitcoins no be wetin I go wish my enemy self.
Na the hard way I take learn say Bitcoin na peace of mind. I been dey think say person fit make plenty money from some kind coins them but before you see those coins, you fit done lose wetin no good.

Anybody wey dey start this journey should focus on Bitcoin first because those plenty other coins them na trap. Them dey suck your money blow you breeze like one bad rat like that.