I greet ona o. I just dey reason how many coin don surface for air after bitcoin. So many of them don fall finish. If you go coingecho or any crypto website, you go see say na everyday coin dey enter market and naso them get short life spam.
Na because dem no get any use case now, plenty of does alt coins no get any use, plenty of them wey dem dey create recently na scammers dey use them, they go just create am, make sure say he get small hype, and dem go dump am on top people wey invest in am. If anybody wan invest in altcoin now make we dey very careful ooo, make sure say the altcoin wey u dey invest in no be new one, make sure say e don spend years in crypto space before and e don experience both bull run and bear market before and e survive am. No just carry urself go invest in project wey never enter market, and make sure say the altcoin wey u go dey buy na d once wey dey better exchange.