Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: The fall of shitcoin/altcoin, the rise of bitcoin
by
CryptopreneurBrainboss
on 16/11/2023, 20:17:24 UTC
⭐ Merited by Pi-network314159 (1)
Now people come dey realise say na bitcoin be the Koko. So I come they think wether na these things wey happen to people naim increase bitcoin adoption pass the way e been dey before or bitcoin for just grow without these things wey I talk.

Abeg make ona shear ona idea on wetting ona think dey increase bitcoin adoption

People never still realize like dat because if dem been dun realized altcoins no for dey get any patronage but if you look the altcoins market, investment still dey flow scatter into the projects them. If you look Binance exchange or other exchanges, even inside this bear market wey things still dey crash, you go see say altcoins still dey market profits for some traders or investors. Altcoin Investment na part of the market so we no go fit commot am. As new investor dey enter the market dem go dey think say altcoins better pass Bitcoin as e go fit give them more profits so we go dey see investment inside them steady. Also wait first make bull market reach na when you go see say people never learn their mistakes as na so so altcoins you go dey see everywhere, even the shitcoins dem go return back and people go dey invest.

As for wetin dey increase Bitcoin adopting, na the popularity of the coin, as people dey hear about am, dem dey do research come dey see say the coin get better track record so dem they embrace am. Also the big companies wey dey accept Bitcoin as Paul they also increase the adoption. Former investors wey dun see shege for the altcoins (as dem go fit make you lose every money wey you Invest if you no use your head well) dey also increase the adoption in Bitcoin. The bad economy of the world dey also increase interest in Bitcoin as people dey find wetin dem go fit Invest inside and secure their wealth whereby increasing it too and Bitcoin tick all the box for that area.