Weti dey happen for here na? Me I no dey understand the whole thing again. Even signature Campaign thread sef now na to translate? When do thing was in one thread, the thing was nicer than like this. Di first time when I see am I even think say Unijoin campaign e don come to do local board for us to participate so when I enta inside I come dey see sae na for translation purpose. By di way, Op u try 4 di work.
For your mind like this I no get wetin I go use my time do abi? 😊 I dey surprise say u dey yan like this because I don see your comments for de ANN thread, so I take am say you too suppose don see wia UniJoin ask forum members to help translate the ANN and post for their local boards? Abi you no see am? Icopress also posted about the translation on de signature thread. Also, look de ANN and you go see links to translations in other languages by members. So I no translate am because of high service or because I want spam de board.
E be like say you been don work for Neolife people before O?😀 @sokani, because if you don't work for them before you go Sabi do advert well well. There second name na orientation (OT) unijoin company people don full here ona well-done. When I see am I think say them don launch New campegn.
Make ona no reason am say people dey laugh ona, na just cruise people dey catch. Anything wey dey give person money sopos make peeson promote am all of us wey dey here dey soar to grow higher. Anything we dey do here na money even if people say some people like am or not you dey use am they make your money dey go. No wahala just ride on we dey your back.