Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: The fall of shitcoin/altcoin, the rise of bitcoin
by
Jegileman
on 18/11/2023, 22:50:04 UTC
I greet ona o. I just dey reason how many coin don surface for air after bitcoin. So many of them don fall finish. If you go coingecho or any crypto website, you go see say na everyday coin dey enter market and naso them get short life spam. People wey never know wetting the happen go dey buy am dey Happy say there future don bright not knowing say na junk then they buy. Tera Luna and FTT coin show people shegge and other ones wey I no no. Now people come dey realise say na bitcoin be the Koko. So I come they think wether na these things wey happen to people naim increase bitcoin adoption pass the way e been dey before or bitcoin for just grow without these things wey I talk.

Abeg make ona shear ona idea on wetting ona think dey increase bitcoin adoption

Bitcoin wey dey increase na natural something and no be the action of any other coin dey make am move the way we see am so. Bitcoin has many factors for its widespread adoption so far but none of them dey related to any altcoin or shitcoins. I have only heard how bitcoin have helped in promoting other cryptocurrencies, like helping them to increase their current price in face of the market. Most of the cryptocurrencies wey reach their All Time
 High na because of bitcoin price action. So I no see anything wey this altcoin or shitcoins go help bitcoin do or achieve from.