When you check you will see that bitcoin price is rising day and night and what price do you think that will be maximum price of bitcoin this year and before we enters 2024, and again what will you advice people to do as the price of bitcoin is increasing.
Where Bitcoin wan fall go again, even though e fall, chances dey say e go increase as halving dey come so oh so if you go dey procrastinate na yourself wey you dey do because Bitcoin go continues dey increase. The time wey Bitcoin been dey low dun pass, like dis we dun dey commot the bear market so na up up wey Bitcoin go soon start dey go. Halving na just next year and people dey rush dey buy and hodl because dem know how e dey be during the bull market. If person wan invest no pursue am say make him come back when market go dey low but help am make him invest but teach am things wey him go need know as Bitcoin investment nobi wetin you go put money wey you go need urgently inside. Make him just invest small amount and hodl like others. If the market fall na luck for ham and make him buy more but no go dey wait for market to fall before you buy.
Normally time don pass wey people go say make we wait make Bitcoin drop small before we go buy, except the person no ey follow market trends, asides Bitcoin halving self, make we talk about the Bitcoin Spot ETF matter wey dey ground for SEC table, imagine say SEC mistaken approve any of those ETC applications wey them send, imagine how investors go carry follow up Bitcoin, all those top top investors them, imagine the kind shoot wey Bitcoin go shoot. Omo me I dey always talk say anybody wey get an for mind to HODL Bitcoin make e no wait oo, na to buy am now because if en dey expect Bitcoin to drop pass like this, e go wait tire oo.
