Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: The fall of shitcoin/altcoin, the rise of bitcoin
by
Prosofina_G
on 19/11/2023, 14:52:00 UTC
I greet ona o. I just dey reason how many coin don surface for air after bitcoin. So many of them don fall finish. If you go coingecho or any crypto website, you go see say na everyday coin dey enter market and naso them get short life spam. People wey never know wetting the happen go dey buy am dey Happy say there future don bright not knowing say na junk then they buy. Tera Luna and FTT coin show people shegge and other ones wey I no no. Now people come dey realise say na bitcoin be the Koko. So I come they think wether na these things wey happen to people naim increase bitcoin adoption pass the way e been dey before or bitcoin for just grow without these things wey I talk.

Abeg make ona shear ona idea on wetting ona think dey increase bitcoin adoption
Shitcoin na decentralized finance way no get regards or value in the program system so any person way go buy am waiting you expect na so ona two go fall yakata.

As for Bitcoin, bitcoin na baba in don dey for the system no be today, in fact na bitcoin be the father of all the coin even investors they invest na say tomorrow no day and na so e dey rise day by day, so na bitcoin hold the market.
This na my own little idea way I learn about bitcoin.