Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 3 from 2 users
Re: [ANN] UniJoin.io - CoinJoin Crypto Mixer: Your anonymity na our priority
by
Cantsay
on 23/11/2023, 09:37:56 UTC
⭐ Merited by Charles-Tim (2) ,Hatchy (1)

Please what do they mean by mixing services, are they custodial wallet provides or decentralized exchange?

Okay make I try explain am the way you go take understand am.

First of all you know say bitcoiners Dey very conscious when it comes to matter wey concern our privacy, so if something happen make we say person send you some coins based on say dem get your wallet address them go fit monitor how you take Dey do transactions and even if you like send am go another wallet he go still Dey show for blockchain. So if you want make the person nor fit see how you take dey run your stuffs nah there mixers go take help you.

The way he Dey work be say you go send your coin to the mixer (dem get large amount of coins for different places) and during the period when you wan take send your coins you go also provide them with the new address wey dem go send your coins go so that way nobody go kon know how you take Dey waka with your coins. Nah just the basic idea be this, but if you really wan know more about am den just check this link[1] wey I go drop for the bottom of my post.

[1] https://www.ledger.com/academy/topics/blockchain/what-is-a-bitcoin-mixer