If dem agree to repair the constitution wey dem dey call amendment, leaders no get choice dan to do the right thing but if the constitution still dey as e dey, omo no way.
Na the constitution say dem go use electronic for election, na same constitution say INEC fit still use manual. That one no be double standard? Dat one no give room for rigging with INEC as we see for this year presidential election wey dem no upload results electronically and court interpret dat side of the constitution. All that na rigging wey constitution itself allow it just takes a political party to work with the umpire and the rest na story as we see for this election.
I believe self say if the constitution reduce the appointment powers of the president and governors, the craze for aspiring for those positions will reduce and those with mind to work for the people will aspire.
Boss, make we forget to dey drag the constitution for this our country matter. Our problem dey beyond the constitution. To me no be constitution be our problem but people wey dey manage our affairs. Constitution dey clear but people wey dey in charge just dey interpret am the way e go suit dem. Like seriously, I don finally agree say na court be our number one enemy for this country because na dem suppose make things right when e wrong but na dem dey spoil am low key.
Imagine during the appeal of presidential election wey APC say PO no qualify to run for the president because he join the LP lately and he no follow due process. The court say dem no get power to interfere in the political party affairs because na internal issue and they struck out the case but the same court sack Kano state governor under NNPP saying that he no follow due process to become the party flag bearer. Same case, different ruling. I remember one of my lecturer's statement that "Judiciary is dead, long live the executive" that's the case of Nigeria system now.
Honestly, the benefit wey dey attached to political office in Nigeria is too much and na why everybody dey rush am and see it like a business venture to cash out big time. Even the America wey dey form father of democracy dey shake head for Nigeria when e come to government expenditure. Unless they cut off some of those benefits, na so we dey chop debt dey go until God knows when.
My point be say even if we amend the constitution and we still have the same people with the mentality of present people on power, e no go kuku change anything.