If this narrative go change for we country e for better cuz I know say even if e dey real na man know man something so before e go come out public na the fake we go see...Na wa
Real things dey come out public too no be only fake things but obviously the fake go plenty pass the real ones. As e be now e get plenty sites wey I dey see online wey people dey say dem dey pay to post but all na fake yet we get this forum wey dey real but people no know about am. Things plenty wey real but na for we to do our research dem well so we no go fall victim to scammers as during this periods dem dey plenty online to look for victims wey dem go defraud, dem know say people dey find money well well dis period to use celebrate Christmas so targets go plenty well well too. This money matters wey dey trend for the country make we no dey too take dem seriously. We need to dey avoid free money and only go for those wey we work.for abi we dun forget say free things dey purge.
Nai make e no good to dey believe anything for social media especially Facebook and WhatsApp and all those fake links
Anything social media isn't to be taken seriously unless you dun see proves say e dey happen. This story fit just be one group of yahoo boy wey dey one side bring am so people go dey click links wey dem dey share and from there dem fit hack people devices. Social media na the home of fake news and sometimes people just dey do this one to trend or for the evil reasons wey I dun talk so. But sha make this one no make you think say genuine things no dey for internet oh as some dey. For the government matter too na so people been doubt the last government exercise wey dem do dey pay people during the buhari tenor wey dem hire some youths to work for the government and dem come dey receive monthly money. Make we just do proper research and we no go fall mugu to this scammers dem.