My contri pipo I greet una oo
Many many times I don see pipo way lose dem funds to scammers and hackers dem.so dis matter way I wan Yan so go fit help us.
To de take start watin b d difference between hacker and scammer? Now many many times pipo de mistake hack and scams matter but true true Dem no b d same.
This one na clear update normally,the rate of scamming now don
Abeg my pipo make we de careful oo bcos e no de sweet at all if pesin lose e moni.
Thanks to Charles-Tim and a other thread way de help us catch scam and hack b4 Dem catch us.
This mata of scam na serious matters at the moment,e get recent survey wey show say d3m dey use people name open opay and palmpay account now..then come dey use am bill people..and them dey fit archive this one when them get hold of your sim(like in a case of stolen phone)or get your actuall account number for regular bank,then use the name open am..so abeg mind where you drop your bank details,especially those places wey give away dey happen..takwuu