For our brothers and sisters wey dey stay around eleme or wey get person around there make una confirm this matter,because like this I no believe anything wey dey comot from this government dem mouth. And person just ask me this question this morning based on say I be Rivers person but I confuse I swear.so may Graduates needs job and dey wait to get update so dem fit put head of available openings..
Even if dem go employ people e no go too plenty like that, d refinery done dey since, no be new refinery, and dey get staffs wey dey collect salary even as e no dey functional, na those people go continue work now, na just few people dem go need employe. If na new refinery wey dem just dey build, na him I go talk say massive employment suppose dey like that Dangote own, but no too put mind say dem go collect plenty people for that porthacourt own.
Make I no too sound pessimistic about di possibilities of dem employing new graduates, because I believe say na naija, we de and before dem put di information for news, every matter of employment go don de settled. I sure say people wey de work for the refinery and people wey get leg and mouth go don secure all di available positions for demselves and for people wey dem go bring. Di wey I see am na by di grace of God, person wey no know person go get employment for crude oil matter, because na for oil di money de and everybody need di oil money. I hope say di news na true and make dem start operation ASAP, because e de very shameful say a whole so called giant of Africa, wey get crude go de import refined petrolatum products