Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: The effects of NEPOTISM (MAN KNOW MAN) in Nigeria
by
Makus
on 03/01/2024, 22:42:34 UTC
Nepotism Na simply when men wey dey in power or position favour their people over the general interest of Nigerians, Nepotism Na weitin we dey call MAN KNOW MAN, like we all know say this country even as work no dey e get people wey dey get work steady, most of them self even when them still dey University them done secure work for them bcos there person dey in power or authority,
Nepotism fit cause plenty damages for the work force of any country, because the  employment Na by who you Sabi and no be by waiting you fit do, most times the relatives wey dem give the job no know anything concerning the work but because they just want am to chop money them employ am,

Some of the effects of NEPOTISM they down
1. E dey reduce the work performance with unqualified employees wey no get that job experience at all.
2. E dey make the country relatively unproductive in some areas for the economy
3. E dey make people wey actually know the work well not to get job, so e dey lead to unemployment most times.

Nepotism no suppose dey any country, bcos some jobs need required skills and specialties no be by man know man,




Na every truth una dey talk? Grin Cheesy. Omor this country no be for the weak at all,  if you no get mind depression go just finish your life. Reason why I dey talk like this na because of wattin I don experience. I been don share this story for this board before, when I finish school, me and my guys been go out to find industrial training(IT). Omor for the entire warri edjeba, any company wey we enter ask if slot dey, Dem dey tell us say for we to gain industrial training experience for there say we gats know one person for inside we be our relatives. Meaning man must know man before we go get a chance of becoming their trainee. Mind you, no be job we dey look for oo. Come imagine say na job, how e wan be? I no even understand where this country sef dey go.