So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.
Na correct talk u talk, my brother. Normal we no say Bitcointalk no be for the weak and to grow from newbie accounts go high rank no be day job. For some parts of the forum u go see as some top oga Dem dey use mouth Tay finish some low rank account and person wey no get patience go fit vex talk back or just reduce e post for forum.
Lol, no be lie, e just be like when I newly join the forum, the very first post wey I make as a newbie, one high ranked user tongue lash me wetin no nice, e tell me say because say I just join the forum, I no supposed rush start to post, say I suppose just dey look other people post dey read at least for some weeks before I go start to post, so I fit sabi wetin to post to avoid forum spamming.
On the other hand, wetin the man talk na actually true if you reason am the other way, but the way e take enter me, and the things wey e talk really vex me, lol I almost wan hala am but I just chill, the experience been dey enough to make me to dey comot body for the forum but then again, I no come here for anybody, I come here to improve myself and to learn for myself and no be for anybody, and na e make I no reason am at all.
These kind of things dey enough for newbies to just stop to dey participate for the forum, but then again, they gats realize and always the reason them dey here and if them do that, then all those kind of things no fit move them at all.