e just dey scary how 99% of the world's data dey on the internet. Even our incognito(private browsing) data sef dey on the internet with our digital fingerprints. Me and person being dey discuss how easy e dey to actually track anybody for this earth as long as say the person dn active for internet before. if no be say some laws dey cover how this big tech company dey take collect our data, some of us wey think say we dey untracable for dn go jail sef. Everything about us actually dey internet as of now, even your "view once" for whatsapp sef. Infact any things wey you thinks say you delete still dey there only say you no get access to them again. Just dey careful of things wey you dey post for internet.
No matter how technology or the Internet may seems to have some negative impact on humans, I still applaud the introduction of internet and technology because if no be dis things me and you for just dey waka like blind people wey no no where we dey go. Technology or rather the Internet don help human being in so many ways to solve human problems because sometimes I dey imagine weda this internet na witch or wizard wey e be say almost anything wey you tell am make him do for you in go do am.
Okay for example let's take the tracking reference you just gave, you no say the heart of man na evil and if no be for the internet and modern technology wey e be say if you commit crimes e get how Dem go take find you out you no no say human being for dey kill each other almost on daily basis because how you wan take no who kill person or how person carry die like for example as Dem dey perform autopsy for person wey don kpeme to know exactly wetin kill am, so all those technology na in dey put fear for people wey get bad motives for where there fellow human being dey so no how wey internet go dey bad wey e go pass the good wey dem dey do or wey dem don do already for human being.