Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: No need to change job due to low salary, just add another source.
by
Uhwuchukwu53
on 05/02/2024, 15:55:47 UTC
My country people good evening inside this evening, today e get one issue wey I just dy reason with one of my guy, so I just say make I share this idea, if e go make sense to some people or not.

The issue na concerning one of my guy wey dy tell me say him dy find another work because the one him dy do, the money too small , say e no dy reach him and his family again, so I ask am how much dem dy pay am? Him say na 90k, i just weak as him tell me the amount, I tell am say, bro ur salary dy fair enough to dy complain like this na, just look for another thing to use double ur hustle, no need to dy look for big job wey no dy come, I even suggest Bitcoin and other business wey him fit add up with this his regular monthly salary.

So why I dy talk all this tins, na to let those people that need to hear this, that most times, no be only our job dy cos our financial difficulty, na  due to poor salary and inflation, na just lack of different sources of income dy cos am, see make I tell you, if you get like three different hustle wey dy pay you the least, weekly or monthly bro you go do well more than you go even expect, just reason wetin I just talk now and how you see am?

For me I for advice him to check the level of freedom the job they give am and find another thing join em way go balance with the freedom, it's unwise to throw away water way you get they expect say rain go fall. The best now to hold we'll find small business or investment way go they solve some financial issue for him, it be Bitcoin, or POS even babbing saloon carry person put they share income allot they to take increase the salary than leaving the job to find bigger one. But if I am to advise him Bitcoin will give him more benefit and freedom if him do it rightly.