Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: No need to change job due to low salary, just add another source.
by
Stable090
on 06/02/2024, 10:26:21 UTC
The issue na concerning one of my guy wey dy tell me say him dy find another work because the one him dy do, the money too small , say e no dy reach him and his family again, so I ask am how much dem dy pay am? Him say na 90k, i just weak as him tell me the amount, I tell am say, bro ur salary dy fair enough to dy complain like this na, just look for another thing to use double ur hustle, no need to dy look for big job wey no dy come, I even suggest Bitcoin and other business wey him fit add up with this his regular monthly salary.
With d way things be now, 90k no be big money like that ooo, if you carry that money enter market say you wan stock your kitchen, na small change you go carry go back house ooo, dis country matter just get as e be, na before you go talk say 90k na big money ooo.

Some job dey wey be say if you don start am, just know say you no go fit do any other work again ooo, e go dey take all your time, and the amount wey dem go dey pay no go really worth am, so if you dey work and you get opportunity for another place wey the payment dey okay pass d one wey u dey do, na to move go that side ooo.

Also you talk about bitcoin investment, person wey 90k wey him dey collect no dey do am, how you want make the person take dey invest in bitcoin, na money dem dey use invest now, and na money wey you no go even need for now dem dey use, no go put money wey you go use chop for bitcoin ooo. If you see the way some people dey suffer, you go know say dey no even fit buy bitcoin self.