So why I dy talk all this tins, na to let those people that need to hear this, that most times, no be only our job dy cos our financial difficulty, na due to poor salary and inflation, na just lack of different sources of income dy cos am, see make I tell you, if you get like three different hustle wey dy pay you the least, weekly or monthly bro you go do well more than you go even expect, just reason wetin I just talk now and how you see am?
Na this thing you talk I been dey reason today say who dey receive #50k as a family man, say E no go easy atol for am to even fit do any tangible thing for himself talk more of to build house and other things. This thing I dey talk no mean say I dey deviate from wetting you dey talk oh, but just almost the same thing that #90k salary you see so E just big for mouth but no even reach anywhere.
Looking for another alternative Naim be problem, because here no be like oyibo land wey person go fit do 3 jobs at the same time. For my country 9ja, to get one single work you go work throughout the hole day. so where you wan get that time to work for another place? And for the Bitcoin you wan introduce am, na investment Abi na signature campaign? Because for this forum no be everybody get the zeal to do this kind thing we dey do here. Because riding na one difficult task wey people dey alway avoid. The reason why you see say people dey even do this signature na because them dey pay, if not who you wan see go get that time to dey read all this lengthy Post?
So it depends on how fast and creative your friend fit be. If not E no easy. Many people wey come with that motive say dem wan come here rank up and start getting money, them come dey post nonsense Thinking say here na Facebook. Not knowing say here dey very Smart and sensitive. If you wan introduce your friend to Bitcoin try explain am very well for am before him go come onboard. If him head no carry am make him just kukuma go learn other online business like affiliate marketing, blogging and other online business them