Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Road to Bitcoin bull run
by
Amphenomenon
on 17/02/2024, 13:08:00 UTC
Anyhow we wey know wetin de for crypto matter suppose try to de do DCA method to de accumulate and hodle Bitcoin, no matter how small, because in approximately one year  time from now, hopefully we go get plenty ROI.

As I see road to Bitcoin bull run all my mind been dey tell me say you wan outline steps wey you go take for the bull market wey dey come for front so but sha the advice good. When you talk about the road to the bull market what are you doing to get the best reward out of the incoming bull run.no be to just dey seat down dey talk say bull market dey come. Wetin you dun plan say you go do to achieve welle for the bull market. From my perspective wetin sure pass na to get steady income wey go dey give you better salary or payment wey you fit dey comot something dey buy Bitcoin.

Economy just dey worst and we dey on God so, any body way still dey save money for bank go suffer more, imagine person way get 100k naira January and person way get 100k worth of bitcoin that January, you go see say one don dey smile while the other one dey complain.
Infact if we get small thing for hand make we just dey gather bitcoin through DCA bcos na Only bitcoin dey effective well for us for DCA, any other investment with DCA nor fit give us watin bitcoin dey give us. As we dey work way DCA be our saving box to get bitcoin

Quote
So dis thread na morale to us say make we no give up for our Bitcoin hodling , based on di economic hardship wey we de face for our country now. Who sow in tears go reap in joy and happiness, e no easy but make we no give up, in di end success is certain.

Motivations like this make sense because na big fuck up say we go dey this industry yet we no achieve anything from the bull markets wey dey front upon all the discussion wey we dey get for here daily. E no matter how small wetin dey your hand dey, start dey invest am so when better block go enter your hand e no go dey hard you to invest again because of you no start dey invest with the small cash wey you get to invest the big ones go dey hard.
The truth be say if person dey save the money, bitcoin go dey rise while our own naira go dey lost value and na the person go still suffer am instead make we just manage, if na to cut spendings tel invest for bitcoin, so that last last we go still Thank God, say we join way invest in bitcoin and that money way small so go soon turn big if we continue to dey invest am for bitcoin.