My naija people I hail una, I hope say di dollar to naira rate wey de make our beloved naira to devalue everyday no too affect una Bitcoin journey to bull run. Anyhow we wey know wetin de for crypto matter suppose try to de do DCA method to de accumulate and hodle Bitcoin, no matter how small, because in approximately one year time from now, hopefully we go get plenty ROI. Bitcoin halving de happen like leap year, because na once in every four years e de happen, and from research, after e happen na new ATH go follow within the next year.
So dis thread na morale to us say make we no give up for our Bitcoin hodling , based on di economic hardship wey we de face for our country now. Who sow in tears go reap in joy and happiness, e no easy but make we no give up, in di end success is certain. But las las, Bitcoin accumulation to bull season no be do or die affair, if we try but no get money to de buy Bitcoin, because of di coming bull run, make we no kill ourselves, after dis bull run other bull runs go still come in the future.
Boss thanks for the advice and also heads up because I no go lie you many of us no wan really miss out on the great opportunity wey this bull run bring because na one of the many opportunities wey crypto lovers for the crypto space don wait for and e don take four years for them to get here but most of us we get to know about this knowledge very late and still we have tried to follow up to see wether we fit gain anything from inside but as you talk am na so the matter be, na hold Bitcoin no be do or die affair but na only person wey know watin him eyes don see when him dey poor go know know if e go really wan see those things again.