e just dey scary how 99% of the world's data dey on the internet. Even our incognito(private browsing) data sef dey on the internet with our digital fingerprints. Me and person being dey discuss how easy e dey to actually track anybody for this earth as long as say the person dn active for internet before. if no be say some laws dey cover how this big tech company dey take collect our data, some of us wey think say we dey untracable for dn go jail sef. Everything about us actually dey internet as of now, even your "view once" for whatsapp sef. Infact any things wey you thinks say you delete still dey there only say you no get access to them again. Just dey careful of things wey you dey post for internet.
is their anything like privacy on the internet? Just do your thing and live your life without being bothered on what on what your data is being used for because the reality is that your data is no safe and the exploitation is increasing at an alarming rate with no one saying anything about it or planning how to stop or reduce it.
If we start to talk about the the rate of intrusion into our privacy, you will even get tired of using your phone. Their are some that believe that your camera takes regular picture of you on a regular bases while you're using your phone, are you talking about the recommendation you get as Facebook ad that comes from the private conversation you had with someone in your chat? I have never considered my data safe no matter if I deleted it or not.
Normally person wey no get anything to hide no dey reason privacy, na person wey get skeleton for cupboard na e dey reason all these ones, like all these fraudsters wey don flood the internet like mosquitoes wey dey fly around. The. Talk say person wey get clear conscience no dey fear anything, as long as we dey sure say e get laws wey dey prevent people wey supposed fit access our personal stuffs wey we put online from doing so, like for those people wey dey store bank details online or other valuable informations. Before them go fit even override protocols for your head to fit release your informations wey dey online, e mean say the person don really do something wey attract international attention for e body. So as long as person just dey live en normal life dey do en things, i no sure if we go get anything to worry about or if we go dey for any danger because we dey use internet.