Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Government demanding from Binance the lists of its Nigerian users
by
Davidvictorson
on 01/03/2024, 14:41:37 UTC
Charles see eh, this matter go long. I tell you. From what I am reading on the internet not from official source though, dem talk say the FG dey accuse Binance based on the following -

If this rumours na true then the Nigeria FG wan just cashout from Binance because say US dun do their own. I been just know say after US successfully make Binance pay fine for the allegations wey dem been give them say other countries go begin dey try their luck and Nigeria no dey carry last so I no suprise to see all this rumours flying around although I go wait first for the FG to come out come talk am demselfs before I go believe wetin you dey talk so. Na the disadvantage of a centralized system be this. Binance need to do anything wey the governments wants or dem go lose the money wey dey Nigeria as alot of crypto traders full their exchange from the country.
This our Nigeria is so confusing. E get report wey talk say FG don slam Binance with $10 billion as retribution. Dem talk say na the special adviser on information and strategy to our presido wey him name na Bayo Onanuga talk this one for one interview for BBC this morning wey be Friday. Another report from Binance Holdings Ltd come talk say weting Oga Bayo talk say na big lie. Dem talk say FG never make any demands like that and say dem nor dey ready to pay any money.

The truth be say me nor fucking believe any of the two sides. Anything dem wan do make dem do. As Odumeje talk, I have many power(alternative exchange for P2P), Hunobi dey, Kucoin dey, ByBit dey.

FG and Binance fit go to hell.