So dis thread na morale to us say make we no give up for our Bitcoin hodling , based on di economic hardship wey we de face for our country now. Who sow in tears go reap in joy and happiness, e no easy but make we no give up, in di end success is certain.
Na true talk you just Yan like this , no matter the situation make we no give up. Sometimes if I dey reason the way things be, E dey tempt me to touch my bitcoin holding but when I remember the advise I dey receive for this forum E dey give me encouragement to hold for long. God no go shame us for 9ja wahala.
But las las, Bitcoin accumulation to bull season no be do or die affair, if we try but no get money to de buy Bitcoin, because of di coming bull run, make we no kill ourselves, after dis bull run other bull runs go still come in the future.
No need for person to kill himself because E no get money to invest in bitcoin. Sometimes I dey even woumder why many people wey dey campaign go dey talk say to invest for bitcoin no easy wey be say na bitcoin dem dey carry pay ona. Na just simple mathematics, as them send you btc as payment na just for you to collect the one wey you need to carry eat sell am for exchange then leave the rest for there make E dey compile, Naim be the easiest way for DCA. You salary na DCA already.