Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: The bad habit of business in Nigeria
by
Barikui1
on 19/03/2024, 04:03:44 UTC
Baba I just talk my mind and I no mean to upset anybody, I no come know why owner won kill me put for just true wey I talk, everybody already know how people wey Dey do business for Nigeria Dey behave, each time wey dollar rise then say their food price don go up meanwhile no be dollar then Dey spend to produce, everything  but then Dey kill us with high price E no go well at all.
Na person wey understand waiting I mean go comment for this my topic.
I make mistake for my post because of network wahala wey Dey everywhere and I don tell moderator to delete one of the posts wey error Dey.
If waiting I talk na lie come and tell me make I follow you talk again and ask you one or two question.


E be like say all the things wey I talk no one enter your ear. A say this forum na mainly for Bitcoin discussion, but most time for local board here we dey deviate small dey talk about other things. But you as a newbie e no good make you start to dey make off topic posts because e go reduce your account reputation.

Then to the main fact. You no just dey share your thoughts or talk true. Since you no like am the easy way, make I tell you plainly so that e no ho be like say I just dey carry talk, like this na spam you dey spam, because we don see this kind of thread more than twice for this local since wey dollar start to increase anyhow. So you making another of that same kind of post, na spam you dey spam, and you fit chop tag because of that one.

The best thing to do now na to just lock this your thread, if you look your bottom left you go see lock topic, use am lock your thread before person knack you spammers tag.
Omo no be Nigeria bord be this? So I no fit post waiting I like and talk waiting Dey my mind Abi?
Oya no vex so, I no won argue with you make you no come carry me for mind. E don do. Sorry sir

See guy man, the major problem wey you dey get here is that, you dy listen to reply, instead of listening to understand first, because by the look of things, you no even understand wetin @makus and @hatchy dey tlk, I no know if you dey understand our pigin well, but wetin Dem mean is that, this thread don plenty for our naija board, people been don talk about something like this, almost like 3 to 6 people, so wetin you surpose do na to go comment under those existing post, instead of creating a new one, Because as you create new one so, na spamming we dey call am here, try to listen to understand and stop to dey listen to reply, because e get why.