I feel bad when I see such post on we local board, sometimes I feel like not coming back here but since to here is no place like home I have to come even if it's ones in a while.
No matter the low quality posts wey people dey make for dis local board, e no mean say make you leave the local board, if hand dey smell e no mean say we go cut am commot. Low quality post dey vex everybody but e no come mean say because of that we go leave d local board, we fit join hands together clean the board, we fit join hands guide the newbies wey just dey come forum, everybody started as a newbie, and no be everybody get person wey go guide them, na from here some people dey try learn. So Abeg no leave d local board because of low quality posters, if everybody leave the local board, then the local board go dey inactive.
Baba, some of this beginners them dey look person les Les, imagine wattin I tell, now say make e lock this thread, yet the thread still dey open, if I report now, them go say I do bad. Shabi you dey see am.
U see say person wey create d tread na newbie, you don tell am make him lock the thread and him no lock am, no dey surprise say him no even sabi how him go lock the thread. Me I no go lie you, as I first come this forum, even if person tell me say make I lock thread, no be say I no go wan lock am but as I no sabi, and I dey fear to ask, awi just leave it like that. As you dey vex make u just calm down, I know say the thread no too go well, and as the OP no wan lock the thread, or maybe him no sabi lock am, then make we self no comment for the thread again, if we no comment then the thread will go down.
But the way you self dey comment, e dey carry the thread go back up again. If we see thread wey no make sense, then make we no make any contribution for the thread, last last e go just be like say dem don lock the thread.