Forget about dollar,any price of goods wey go up for naija no dey come down again.see the price of garri,garri wey na we dey produce just dey rise anyhow and if you ask those market women,dem go say na dollar cause am say no be dia fault
For dis country, everybody get part wey him dey play wey dey spoil d country. Politicians na them be d first problem wey we get for dis country, na from them Nigeria problem start, follow by all this big business people wey dey dis country, the once wey get companies, follow by the normal traders and farmers wey we get for dis country.
If you enter market now, you go see the way all those business people wey dey market go add price, even if dey just hear say d goods don add price from company, before you know, dey go increase the price of the one wey dem get for store, but make dem hear say goods price drop from company, dey no go drop price ooo, na y if price things go up, e dey hardly come down be that.
Wetin government suppose do na make them get people wey go dey regulate prices of things for market, but the problem be say, even people wey government wan get, most of them are corrupt also, na money dey go just dey collect from people wey dey sell for market.