Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Never assume things, always Validate
by
DubemIfedigbo001
on 11/04/2024, 06:10:04 UTC
Your point therefore is make people no dey dey hasty in what dey do and make dem still put little effort to try to be sure of wetin dem want do regards to wetin dem hear from hearsay, assume or believe. E make sense.
Confam, na my point be that, make we dey go the extra mike take confirm facts before we turn am to truth, come use am dey do our things and make certain decisions from it.

Quote
Again, e better make we dey hear from both sides before we go take side, very important. This particular one don put people into trouble especially where couples dey involved, husbands and wives suppose to confirm with each other wetin somebody else do before dem go begin act. Like especially some men no dey confirm wetin their wife tell them against a particular neighbor and them go begin carry face or fight the neighbor.
I no even reason this point earlier, I love as you mention am here, assumption dey pit people for personal prisons in their relationship with one another. When you dey act on simply wetin you hear from one person, naim be say your judgment no balance at all, that one na serious lack of maturity for your end

Quote
if you delay a scammer, he will not succeed because dem go only catch you if you dey in a haste to collect from them by responding and following what they are saying.
Yes, scammers leverage on people's hasty conclusion from their realistic lies and greed. A greedy man does not go the extra mike to confirm the authenticity of the scammers offers thereby assuming they're legitimate. They pay the huge price from their lack of validation with serious loses of assets and funds

Assumptions can also lead to real loses when you make investment based on assumptions. There are many altcoins that can be tempting to invest in based on the hype from friends and some other strangers on the internet, it will be a terrible mistake for you to make assumptions on a coin before investing because then the risk on your investments increases.

E get one popular talk that year for school, assumptions na the mama of fuck up.
I been fall for this in 2021. I literally bought many tokens come dey think say I go blow from them. I no know say na father Christmas I dey do. Now most of those projects den no even list am, I just dey see them for my wallet doing nothing.

I don Wise up now, before I even mine any coin, I go take my time read the white paper to observe very well If the project get better roadmap, abi na some time wasters dey promote am.