Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 2 from 1 user
Re: Why some newbies dey quick lose interest for the forum??
by
MainIbem
on 13/04/2024, 16:22:12 UTC
⭐ Merited by hugeblack (2)

Na correct talk u talk, my brother. Normal we no say Bitcointalk no be for the weak and to grow from newbie accounts go high rank no be day job.

This point wey you make really grab my attention, to be honest Bitcointalk no be for the weak. And despite the criticism and backlash wey be normal thing wey most newbies experience, to grow for this forum person go need patience with zeal and willingness to learn. Also person go need dey tolerative and overlook the criticism. Our people say who give up na em fuck up, so I believe say those wey give up no get patience and dem no dey willing to learn that's why them dey give up easily over small criticism and backlash by senior forum members. For the forum endurance matters a lot, if you notice na those wey get endurance, wey overlook the criticism and improve with the things they learn from this forum na them wey rank up and na them dey enjoy the benefits of the forum currently, that's why oyibo say, "patience is virtue".