Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: Don't keep your hope in any news of bitcoin
by
CryptopreneurBrainboss
on 02/05/2024, 08:44:42 UTC
⭐ Merited by Igebotz (1)
I realize say after di halving, many newbies de expect say Bitcoin price go begin to surge and we go enter bull run immediately, but di reality now be say price de dip di more everyday, and some of dem panic and de rush to sale dem Bitcoin, but di truth be say research don show say bull run no de start immediately after halving. Any investor wey de hudl Bitcoin no suppose to de focus on di short term pump and dump price speculations, because na long term project im suppose be.


I remember say I dun talk for similar thread for this local board based on this same issue. We no suppose dey fear when Bitcoin dey crash. How bad can it be na wetin we suppose dey ask ourselves because no matter wetin the market like we're no longer in the days of the continuous bear market. Na bull we dey enter like dis so no matter how Bitcoin fall reach in a few period of time e go begin to go back up. If na those days of bear market na when we suppose to dey fear say Bitcoin dey fall but for now make we just dey see all this ones as initial gra gra wey Bitcoin dey do to drive away weaker hands so only those wey get full confidence go benefit when Bitcoin begin dey increase.

This one wey the OP dey title this thread say make we no keep hope on any news of Bitcoin I no understand because if we no keep hope, how we go get mind dey invest inside Bitcoin. The thing just be say make we no believe say na this particular time wey Bitcoin go increase or decrease because anything can happen. Wetin you need to dey do na to dey buy Bitcoin and dey hodl, future go reward only those that had the patience to hodl unto their Bitcoin.