Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Crypto is really helping
by
sotelorene
on 07/05/2024, 21:25:51 UTC
Ona good day ooo. Sometimes I dey wonder waiting this world or this country for look like if crypto been no dey because the rate of hardship in this country is too much and waiting dey cause some of this hardship na selfishness and man know man which most people call tribalism. Imagine where pesin go commot go look for work pesin wey dey in charge go tell you say no vacancy or chance for you mean while there is vacancy and you are qualified for the task but because you are not from same place with them, they will deprived you of the opportunity. Now, those vacancy, chance or slot they use to buy it and the people wey dey buy am na the big men, so times dey go buy slot keep for pesin wey no dey qualify for the job or dey go buy am keep for pesin wey never graduate from school. All these things dey very annoying, in fact e dey discouraging but I go advice everyone to keep pushing one day e go turn around for your good.

This is one of the main reasons why Naija no dey develop. This has seriously affected all part of the country. Imagine when contract are awarded to incapable people just because they know one or two political person. Employment are not mostly done on merit basis rather that man know man. Almost all session of the country has fallen for this type of corruption. Things can only turn better if this can be adjusted especially from our leaders.

Na waiting eye dey see people oo for this country wey we dey so and na because of this thing wey the slogan "school na scam" take come out. How person go struggle for like 3-7 years for school depending on your course sha, you come graduate come dey look for opportunity, e no really make sense na. I dey always thank God for crypto oo, just like waiting I talk for my previous post. If person go fit see the amount of corruption wey crypto don prevent for this country  Nigeria to be precise, you go marvel.

Crypto na the only thing wey don give most people hope for this country because right now whether you be graduate or you no be graduate crypto dey very open for everybody and e don make most youth de so independent of the Government because on how you dey with your smart phone, you no need too worry yourself again because crypto dey. Though even with this bad Government some people grace too strong na waiting make even without tribalism they still dey get work and them dey run am together with crypto.