Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: OKX has stopped its p2p service for Nigerian customers
by
CryptoHeadlineNews
on 09/05/2024, 04:01:29 UTC
But one I know for sure be say even if government try succeed to block NGN p2p trading on all angles, Naija boys go always find a way out even if eh go cost us more fees.
If dem delist trading in Naira on every centralized exchange wey dey available to us, then we go either begin trade in decentralized exchanges or we go begin use local vendors, the thing be say using local vendors dey very risky and vendor wey you trust today, fit carry your money run tomorrow. As e be now, we still get a few centralized exchanges wey we go fit use, and make we hope say things won't get worse than it already is.
And apart from those decentralized exchanges and local vendors, there are still other many alternatives in which I dey pretty sure boys go fit dey execute BTC to fiat transactions, and by that I mean either trading/selling BTC for US dollars or British pounds, and then converting our US dollars or British pounds to Naira, sharp.. But one thing I go like be say make people no loud this format, just the same way they were able to immediately expose other means of trading NGN immediately Binance was banned on Twitter, hence, making government know about those exchanges, and now NGN have been delisted.  So if only we fit keep things secret, eh go hard government know our next move.