Wetin be the need we call here LOCAL BOARD? No be to behave local? Wen we go outside this section we speak all the loads of English wey full our mouth. Make we behave local for this board abeg una English and educated piple.
Local boards are where locals communicate and discuss common goals. They are not limited to Nigerians, so you can post on any local board as long as you can communicate effectively in the language and so on. The Naija board is not the only one where people speak in different languages; this also happens on other boards. Have you considered what will happen to other Nigerians who do not understand or know how to write in Pidgin if the board is restricted to only Pidgin?
So many factors were put into consideration before deciding on the language accepted here.
Mr Igebotz I no sure if I understand your English as no be pigin you take post am. But the thing be say make we no hide from the truth. Ok them say make we only use pigin and you dey consider members wey no fit understand am, wetin con happen to learning? I learn how to write for pigin by asking piple wey dey around wey sabi and understand, nothing spoil if we ask for help for wetin we no get or understand.
I no dey against the use of English to post but e too much, make we tell ourselves the truth. Post in English oh but make we limit am at least for ones make outsiders find am hard to understand our communication for the board, no be small thing them don put one or two together to get the main Koko wey we dey talk about.
So make una no dey see am like say we no want English for this LB at all at all. For the Proverb and Meaning thread you see say English plenty dia? No way, here sweet when the English no plenty, you check am nah. About the factors, my broda if no be pigin how we wan take know say nah naija board be this? Naija board without pigin no be
Nigeria Local Board.