Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: We all know the rules
by
Igebotz
on 23/06/2024, 07:49:59 UTC
Mr Igebotz I no sure if I understand your English as no be pigin you take post am. But the thing be say make we no hide from the truth. Ok them say make we only use pigin and you dey consider members wey no fit understand am, wetin con happen to learning? I learn how to write for pigin by asking piple wey dey around wey sabi and understand, nothing spoil if we ask for help for wetin we no get or understand.
I no dey against the use of English to post but e too much, make we tell ourselves the truth. Post in English oh but make we limit am at least for ones make outsiders find am hard to understand our communication for the board, no be small thing them don put one or two together to get the main Koko wey we dey talk about.
So make una no dey see am like say we no want English for this LB at all at all. For the Proverb and Meaning thread you see say English plenty dia? No way, here sweet when the English no plenty, you check am nah. About the factors, my broda if no be pigin how we wan take know say nah naija board be this? Naija board without pigin no be Nigeria Local Board.

Background matters; not everyone grew up in an environment where Pidgin was widely used, and if they couldn't understand or write Pidgin properly all these years, they're not going to do it now just because some local board rules required it; instead, they'll post where they're needed, which is the discrimination we don't want. Pidgin is not our official language, but it is widely used by second and third-class citizens such as myself and you; first-class individuals lack such exposure, and some of them are on this board.

Our board is the most difficult place to read because Pidgin hasn't been added to translation tool yet unlike other Local board where Google translate everything to English the moment you open the board.

If I write my post in Pidgin I bet you say you go no understand one slang inside.