I discover how some newbies wey register here, after them don drop some posts and e happen say one of the posts receive backlash, you go see say gradually, that user go start to dey scarce for here and before you know e go twy before you see them.
Most of dem no really get orientation before dem join the forum, Dem dey reason say if you just enter and you post, then merit go Dey enter be that, and dem go rank up, but if dem post finish, and dem see say people blast their post which is normal on the forum here, they will be disappointed and most of them go give up, some go talk say dem no fit do am. But Wetin I go tell most people be say, no matter how dem talk bad about your post, e no mean say make d person give up, just ready everything wey everybody post, and make you try correct yourself, gradually you go improve.