E no easy for this industry wey we dey so. I know say I dey follow people wey dey advice to focus on investing in Bitcoin but I know say e no go easy for many to follow because me too e no been easy for me when I start to dey invest in industry newly because while you dey get 1x for your own investment your friends dey make 10x and above for shitcoin/altcoins (e go come belike you no dey dey industry) and e go worry you to wan follow them but when you do your own, you go begin lose most times and this particular one na greed but e go some wey be say the cause na say no information was given (like dem no know at all)
That feeling dey there, but after I listen to Warran Buffet advice, I learnt my lessons. That man talk say, no be about the return wey you wan get, but na about how much you go lose if you no fit get that return. Na there be the investment focus. And if we examine that him talk, we go understand say bitcoin no go make you lose all only if you get patience but plenty of shit coins go make you lose out for ever.
As senior man talk, e fit give you X10 and e fit collect you too, so e just dey like gambling.