Hmmm! this one na correct ogbonge history of our local board with facts and dates join oo.. as i dey read am na so my body dey sweet me ehnn, e be like say i dey read history textbook. @hatchy you too correct boss for this thread wen you settle down put together for the benefit of our knowledge, if i to say i no see this thread come read am, i for no believe say we get tory of how we take get our own board for this forum, thank you. and special thanks to all the senior men them wen fight for the purpose of us getting this our local board, if we dey celebrate our heroes past, una name suppose join, because i see am say e no easy for una but una still run am.
But as my oga @CryptopreneurBrainboss don talk am for here say him for appreciate am more if to say na when we dey celebrate our 5 years or 10 years anniversary this our tory for come out..,
Although the thread wasn't necessary as we're barely a year old but I appreciate the effort put into creating the thread. Maybe if this thread been dey come out in our 5 years or 10 years anniversary na when I got see more importance to the thread but anyhow sha kudos for reminding us where we started from.
Me self go really like to suggest am say make we dey celebrate our anniversary and anytime wen we dey celebrate am, make we dey remember to celebrate these men them wen stand as foundation for us to take achieve this our local board as i don see am say this na big achievement for us Nigerians wen dey this forum. i greet the house.. happy new year to all of us.