Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: I trust BTC more than I trust my bank
by
DubemIfedigbo001
on 19/02/2025, 13:45:10 UTC
My friend was like this one wey you carry all your energy and almost all part of your income dey invest in BTC make BTC no give you high blood pressure one day oh no say I no warn you oh, I was like see this one me wey trust BTC pass my bank, BTC is a typical example on how human being dey take dey crate value for them self no be rational currency, like fiat money oh everything about BTC now legit one, the volatile history clear, market value clear, store of value clear, so wetting you won tell me again, and him come say since you are investing in what you believe there no problem, and me too told him believe what you know my trust for BTC ney wetting dey motivate me into the future mostly now wey we dey bull run.
You dey try as you be newbie here, come take BTC serious as your story show, na better thing to believe in Bitcoin and e still make sense say you no just dey procrastinate, but you use action follow up your belief. I go still like reason you say make you no invest more than you fit loose inside BTC. As your friend don dey advise you say you fit get high BP for the matter, e show say you fit dey over aggressive for your investment. BTC na money wey remain after you don take care of all your expenses naim you go carry part of am take buy BTC, come keep some part way you go use hold body in case of emergency and other things wey fit sup for you while you dey invest for BTC with long-term plan.

BTC get em own use, Bank get em own. All of them dey serve different purpose. BTC na for investment purpose make you take secure your financial future, but money we're you defy take do shall expenses for your life, e no dey advisable to put an for BTC, those ones go dey Bank as em dey easier to transfer am from bank and if you don rush go put am for BTC, you fit need am when BTC price dey down and you go sell with loss.

So if na for investment opportunity, you fit trust BTC pass your bank, but if na money you go need for short while, then you go trust your bank pass BTC