Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Scared to hold Bitcoin?
by
Troytech
on 25/02/2025, 17:33:23 UTC
We know that there is no specific time to invest in Bitcoin.

Broda, just like every other business get season wey money dey take enter inside, Bitcoin too get time wey be say if you invest, you go make more profit and faster. Like for example, to invest for halving year make sense more so that halving happen like this na bull be the next thing. If you invest for bear season, it will take a longer time for that investment to grow and if you no understand the system you fit vex sell am at loss. So except you dey ready to forget the Bitcoin for your wallet then you fit invest during the bear. Otherwise, the best time wey you fit make fast money for btc na halving year because e no go too tay wey the price go begin appreciate.
You talk well, but also try to understand am from the other view, no too make sense when be say the funds done dey ready to buy Bitcoin but based on say no be the dip season wey price done too fall to buy Bitcoin you come decide not to invest, Bitcoin dey profitable to invest at all times, but the opportunity to buy very low go give the best profits, so instead of waiting for the market to fall finish, the investor fit dey apply the DCA inside their investment, at least make in no be say the funds just dey account from there come later shift his purpose.

If you go like take Bitcoin as investment, no need for fast money mindset, long run na the best.