Post
Topic
Board Politics and society (Naija)
Re: Negotiations for peace deal wit bandits go fit solve Nigeria insecurity palava?
by
Majestic-milf
on 04/03/2025, 07:49:26 UTC

My countri people I say make I share this matter with una, una remember say kaduna state before na horror of bloodshed as bandits bin dey cause  alot of casala inside de state.Today kaduna state don become one of the most peace state for Naija based on the peace deal wey the new govt bring out, na make I say make share am with una like if other govt apply the same method,insecurity for Nigeria fit come to an end.

Abeg talk your own matter on how you take see am.



I no wan look like bad belle or anything but this peace tok wey take place for Kaduna and the ensuing peace wey the residents dey experience go be for how long? The country wey I know get the habit of doing tins for them own selves and what if this nah sometin wey govt promise the people and then dey kind of settle these bandits make e be like say the whole tin don stop but then go still call on them when them need them?
 The truth be say e no go be bad idea if other local governments apply this strategy but for how long wey them go fit ensure peace and security for their different states wey go in turn affect the country? I dey tell people say the key to making this country beta dey our hands but most times we dey let ourselves be used by these people for their selfish gains.