See how selfishness don dey make Rivers state dey drift small small. D state go soon witness big gbege wit dis judgement I trust dem for dat state na. Gun fight go soon happen. E nor kuku dey hard dem.
Na wit Wike I see endless selfishness and people not fit confront am. He wants to continue be govnor even after im tenure ended. He defected with his actions and behaviour from PDP to APC, yet PDP dey fear to expel am. E get wetin Wike take hold dem for blokos wey dem nor wan tell us and na im make Wike dey behave uncontrollably like an emperor.
We pray make the matter no reach that level because already Riverine Tribes/ communities don send warning threath to Wike and Martin's led assembly say " Any attempt to impeached Gov Fubara from Office say na declaration of war'
From the way wike has been boasting on national TV, you will know that he has a hand in the judiciary and is being backed up by the presidency, the fight is a fight that the governor alone will find it difficult except the good people of Rivers state come out en mass to support him, this is a fight against the federal government,
Of course Wike hands will definitely be on that, one thing about that man be say when him done they against you him go make sure say in go do everything to turn things very bad, lately I they even they hear say them won remove all the Local government chairman way they for River State and na the problem way they now for the state because I no sure say any of the council they open now because of that so that them no go attack anybody.
we never no when that issue go they resolve, Wike just they do like say na him own everybody and whenever things get contrary to his wheel he takes it by force, his connection in the country is just what is backing him if not he would have reconciled with the governor.
Supreme Court don already annul the election and Gov Fubara don already make speech concerning the matter,the Governor say his administration go Obey supreme Court ruling concerning the LG election,the Governor come further say make all the LG chaimen vacates their seats and make handing over immediately.
Secondly Wike don already promised President Tinubu say him go deliver Rivers State to APC and that's why President Tinubu dey give am maximum support and backings. Wike don already prove to Gov Fubara say na him Wike be the real Boss for River State.