Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: TRADING IS NOT GAMBLING
by
IceLincoln
on 08/03/2025, 21:08:32 UTC


I no fit talk all the differences here but these ones na the key ones I know say others get too to add, but las las abeg trading and gambling no be the same thing,


True true trading and gambling no be the same thing, na two different things wey fit wound you wetin no good, but one major thing wey I pick out from your write up is that luck fit shine on you in gambling, but in trading, if you no know anything about am, you don enter one chance because luck no dy work for trading, you earn base on wetin you know, and how  good you can control your emotions, but as for me, I see two of them as a dangerous game, especially trading because him dy even more brutal than gambling.
The emotional trauma wey come with trading is second to none, that time wey you no dy trade, you go feel like say na that Times you for make enough money, but once you enter wrongly, ur eye go clear, because the market go humble you sharp sharp.
Omo this na age long argument, but the way I see it Trading is a kind of gambling.
All you listed as differences are also involved in it as similarities for example person wey Dey play game (whot, ludo, even football) Dey bet on em skills, knowledge and strategy to win not just luck as stated.
Yes, Most forms of gambling depends mainly on luck even person wey Dey trade need luck on em side not jus the knowledge and skills cos with all those analysis you can’t really predict the market 100%.

My Verdict on this is that TRADING is a FORM of GAMBLING where the risk/losses can be managed.