So lately I Dey see many post about the comparison if gambling and trading, our problem be say we nor wan learn we just wan earn , because we Dey see traders life style via social media , so we come picture trading as means to get rich quick not knowing “ is the hardest way to make easy money “.
I Dey talk base on experience when I start trading back then I nor bother to go deep in the learning aspect I just go for the basic knowledge, with the mindset of if the price come down I go buy if e go up I go sell after everything I end up regretting my actions after countless losses if nah say I calm down learn first I for nor go through those kind losses .
We just wan go the destination without knowing or experiencing the journey, all successful traders went through this stage you are in now before getting where dem Dey so , Dey pass through the journey .
So drop some mistakes wey you know shey people Dey make for trading well well if you get any .
People wey dey folo folo signals without knowing what it means in correct details and then they come allow themselves use fear and FOMO dey trade, dey always enter problems.
Trading signal no too bad like that if you dey fit get the update drop on time and you the trader come gat Sabi use know how to apply the signal too. The problem wey plenty people the get about trading signal nah say some of this signals fit reach you late when the right time to apply am on the particular coin you dey trade with don pass or you fit even the go use signal of 1hr trading timeframe for 4hrs timeframe which fit cos you losses too.
And funny enough sef, people Sabi use large sum in trading when it be say nah one alleged professional na send them this signal onto say them no wan fail from making massive form the opportunity. Na this one be the FOMO side shaaa