So lately I Dey see many post about the comparison if gambling and trading, our problem be say we nor wan learn we just wan earn , because we Dey see traders life style via social media , so we come picture trading as means to get rich quick not knowing “ is the hardest way to make easy money “.
I Dey talk base on experience when I start trading back then I nor bother to go deep in the learning aspect I just go for the basic knowledge, with the mindset of if the price come down I go buy if e go up I go sell after everything I end up regretting my actions after countless losses if nah say I calm down learn first I for nor go through those kind losses .
We just wan go the destination without knowing or experiencing the journey, all successful traders went through this stage you are in now before getting where dem Dey so , Dey pass through the journey .
So drop some mistakes wey you know shey people Dey make for trading well well if you get any .
You having the mindset to sell when the price went up and buying when there is a dip is not a mistake it is your own strategy that you feel will be okay for you and that your mindset na sport trading mentality and I think people with basic knowledge should engage in that because it is not that risky like future and forex trading. The mistake person fit make for this trading of a thing na to go use waiting you no fit afford to lose go trade because if you try am and peradventure you incur loss you won't forgive yourself that day you will so regret and blame yourself and you may even go as far as blaming your ancestors sometimes.