Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Mistakes wey people Dey make for trading
by
Stable090
on 09/03/2025, 20:14:33 UTC
So lately I Dey see many post about the comparison if gambling and trading, our problem be say we nor wan learn we just wan earn , because we Dey see traders life style via social media , so we come picture trading as means to get rich quick not knowing “ is the  hardest way to make easy money “.
Plenty people just Dey see am for social media say people Dey make money from trading, some people na just from friends dem Dey hear am say people Dey make money, Dey go wan jump into trading also say Dey wan make money, Dey won’t even care to learn about trading, they just wan Dey make money, na why most of dem go Dey look for signal groups up and down, and signal groups owners self go Dey brainwash them, Dey just want make people join their group, so that Dey go see money chop, immediately you don pay dem, nothing concern them again ooo.