Anyway sha OP, d thing wey you carry for mind to do nor be bad thing but na bad timing and unnecessary exposure and gbege for yourself. You sabi how insecurity nor be anybodi friend for we kontry now. Doing dat go mean sey you just wan expose yourself to risk where nobodi send you work oh. We dey preach privacy and anonymity for dis industry. Nor go use youthful exuberance take expose and cause yourself regrets. If boys hand touch you, you go realize how needless d points wey you wan prove dey.
Baba e good as you open the Op eyes with these reasons o. Nah only for naija wey when person use crypto we police pipo go think say nah yahoo person or e dey into fraudulent activities. E go be novel idea to use Bitcoin pay bride price but the question nah say Op go fit ready for the unnecessary attention this him stunt go bring or again, will the parents of the bride accept such a means of payment?
Nothing bad for all the ideas Op bring o, but make e no be like say in a bid to do something wey nobody don fit do, him go come bring more wahala instead of good.